INJ COIN
INJ na di token wey Injective use for staking wey dey happen when you put your money to earn more. People wey stake am fit join hand decide wetin go happen for here.
Di main coin wey dem dey use (Base Denomination)
INJ dey use Atto as their number 1 money unit. This na to make sure say dem follow Ethereum stand gidiba. E be like say dem and Ethereum dey waka for the same shoe size, dem no wan dey drag who get bigger leg!
1 inj = 1×10⁻¹⁸ INJ
Dis dey match wetin Ethereum get:
1 wei = 1x10⁻¹⁸ ETH
How INJ Token Take Work for Injective (Injective Token Economics - Tokenomics)
1. How Proof of Stake Secure for Injective
Di Injective PoS blockchain dey follow di native INJ token.
Di token fit use for many tins like governance, staking, and to capture value for dApps.
Dem start with 100,000,000 INJ tokens, but e go dey increase over time through block rewards.
Dem plan for INJ to increase 7% at the beginning, but e go reduce to 2% later. E fit be say the total supply of INJ go even dey less than the way dem start am, because of the way dem take do am for di Exchange Fee Value Accrual section wey dem explain for down.
2. Governance
Di INJ token na di main token wey dem dey use to control and govern di Injective Chain.
Dem go use INJ token for all di aspects of di chain, including:
Auction Module: Parameters
Exchange Module: Custom Proposals and Parameters
Insurance Module: Parameters
Oracle Module: Custom Proposals
Peggy Module: Parameters
Wasmx Module: Parameters
Software Upgrades
You fit find di full details about di governance process for here.
3. Exchange dApps Incentives
Di exchange protocol dey use wetin every eye dey see wey be chicken change trading fee = 0.1% for who dey carry come(makers) and = 0.2% for who dey carry comot(takers). To put hands make exchange dApps dey do plenti plenti buy and sell for di platform, dem go shake hands with envelope for exchange dApps wey bring orders to di shared orderbook with = 40% of di trading fee wey come from di orders dem bring.
4. Exchange Fee Value Accrual
Dem go use 60% of di exchange fee wey go surplus(jara) for on-chain buy-back-and-burn event where dem go auction off di total exchange fee basket to di highest bidder in exchange for INJ tokens. After dem sell di exchange fee basket, dem go then burn di INJ wey dem get, wey go now reduce di total number of INJ wey dey available.
You fit find more details about di auction mechanism here.
5. Collateral Backing for Derivatives
For Injective, dem go dey use INJ tokens like kpako for margin and collateral for all dia derivative markets. No be only dat o, for some kin derivative markets, you fit also use INJ as collateral backing or insurance pool staking wey you go jus stake your INJ dey chop interest on top am.
Last updated