Governance
Governance
Injective chain no be just any blockchain, na like a family business wey everybody get say. If you stake your INJ tokens, you don turn family, and that mean say you fit join the dey put mouth for wetin go xup through governance.
Reason say you dey live for a big compound (Injective chain), and you and your neighbors (other INJ stakers) dey decide how things go dey. You fit propose changes to the rules, how things work, or even new features for the compound. Any idea na welcome, from small tweaks to big upgrades.
To Submit request
To folllow put head for wetin dey xup, you fit submit wetin you wan see for di governance portal, wey be like di community suggestion box. Once your proposal dey de, everybody fit see am and vote on whether na wetin dem reason or no be. Na democracy for the Injective family, nobody dey steal mandate.
Small rules dey for proposal. Dem no be hard, but e dey important to sabi wetin you dey do before you throw your hat for di Injective governance ring. INJ deposit wey be way to show say you dey committed to the Injective fam. You gats put at least 1 INJ for table before you drop any proposal. For your proposal to even reach di voting stage, wey everyone fit gree or no gree, you gats deposit another 500 INJ. This one na di "serious business" deposit, wey show say you sef believe in yourself.
Voting Period
Once you keep your money for table and you don talk your mind, that your proposal go become election candidate for four-days. E go pass through a four-day voting period.
33.4% of INJ holders gats vote on a proposal for dem to reason di vote, and 50% of gats vote “yes” for di proposal to pass.
Voting Outcome
If di proposal pass, our contributors go begin put hands to make am make sense. If 33.4% of the total vote is NoWithVeto
, the proposal no carry weight be that, or the minimum deposit no come touch wetin dey ground, wetin you put go burn.any thing wey pass this two, na refund.
Last updated