Staking
Staking na like to put your INJ tokens to work, like you dey save dem for a bank wey go pay you interest. Instead of to dey collect dust, your tokens go dey help keep di Injective chain safe and smooth.
Injective chain dey work with wetin dem call proof-of-stake, wey mean say instead make everybody di fight about who go validate transactions, you fit just stake your tokens and validators go run everything for you. Na less work for you, more gain for you and the chain.
Stake INJ
Ready to make your INJ tokens work for you and earn flexing moni, Na staking go run am for you!
To comot your staking rewards
Staking INJ be like to plant a money tree. From when you put your INJ for ground (with the validator), your reward go start dey grow. You no need to do anything special, just let your INJ work their magic.
To see wetin dey xup, you fit put eye for di staking section forInjective Hub. Na like your personal bank statement, wey show you how much your rewards don grow. And when the tree don bear enough fruit (na when you don earn enough rewards), you fit pluck them anytime you want. Na to just press withdraw and your sweet INJ tokens go land for your wallet, ready for spendings or staking (as saps choke reach).
Redelegate
Redelegating na movement. E go help you move your staked INJ from one validator to another and you no go wait till the 21-day unstaking period. Redelegating dey happen sharp sharp.
Undelegate
You want to take your INJ tokens back from the validator and stop earning rewards? No wahala, na undelegating be that. Just remember e dey take time. Na like giving your bank a update before you go comot your money. You gats tell the validator 21 days in advance sayyou want your INJ back. Na like a cooling-off period, wey make sure everything stays smooth and safe on the Injective chain. From when you startdey undelegate, those sweet rewards no go dey flow again. Na like pausing your money tree until you get your INJ back.
Last updated