Messages And Transactions

Abobi

Dis document go break down two important things for Injective Chain: Messages and Transactions. We go explain what dem be, how dem work together, and how you fit use them to change things inside the chain.

When you wan run any matter for Injective Chain and change things inside, na two main steps dey involved. One na to create transaction, Na like writing letter wey tell dey di chain wetin you wan do. You write the details of your action, like sending money or swapping tokens, inside dis transaction. Na like making your request to the chain. Di other one na to Sign and Send. Before you send this letter, you need to put your signature on top am. Dis signature na like your secret code, wey show say na you wey write the letter and you agree to do wetin dey inside. This signature dey come from your private key, wey be like your personal padlock for your Injective account.

After you sign the letter (transaction), you send am off to Injective.

Messages

Messages na like instructions wey you give Injective wetin you wan change inside di chain. Every transaction gats get at least one instruction (message). Imagine say you wan run plenty things for Injective. You fit write all your instructions for one big transaction instead of to run am one after one. Na like putting multiple requests in the same envelope. Like dis, you go save time and effort, and the chain handles all your run everything for di same time.

Transaction Context

If you comot message(s), every matter for Injective get wetin follow am gumbody. These details fit includefees, accountDetails, memo, signatures, etc.

Last updated